1For di elevent years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di mont, God kon tell mi:
2“Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’
3Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: Tyre town, I bi una enemy and I go bring many kountries kon fight una and dem go kom like wave for sea.
4Dem go distroy una town wall kon tear una towa. Den I go swip all di san-san komot der kon leave only di rock.
5Pipol wey dey katch fish go dey sun dia net near di sea for der. Mi God don tok and dem go distroy Tyre
6kon kill pipol wey dey inside di town with swod, den Tyre go know sey na mi bi God.”
7God wey get pawa sey, “Make una listin, I go bring King Nebukadnezzar kom from Babilon, e strong pass evry oda king and e go attack Tyre. E go kom from nort with many sojas and shariot.
8E go distroy una land, den e go attack una kon build wall round una town.
9E go skata una wall kon break una towa with iron bar.
10Di dust wey en horse dey kause go kover una. Di shariot nois go shake una wall as dem dey pass una town wey don skata.
11Di pipol wey dey ride di horse go skata una street kon kill una pipol with swod and dem go break una strong pila rish groun.
12Una enemies go kollect una money with evritin wey una get. Dem go break una wall kon skata all di house wey una build with betta money. Dem go take di fine stones, wood, rubi and evritin, den kon trow dem inside sea.
13I go stop all una song and di music wey una harp dey play.
14I go leave only one small rock, so dat doz wey dey katch fish go dey sun dia net for der. Dem nor go build di town again. Mi, wey bi God, don tok.”
15Oga God tok to Tyre town sey: “Wen dem dey win una, doz wey dey stay near di river go dey fear, bikos of pipol blood wey go dey flow pass.
16All di kings for di kountries wey dey near river go kom down from dia throne. Dem go pul dia crown and fine-fine klot komot body kon sidan for groun dey fear bikos of how dem dey distroy una town.
17Dem go sing sorrowful song for una sey: “ ‘Di town wey evribody know, don skata! Na en ship bin full di sea before, en pipol bin dey rule di sea and dey make evribody fear.
18Naw, for di day wen e fall, di land for di sea centre go fall too and di pipol go fear, bikos of how e take skata.’ ”
19God wey get pawa sey: “I go make di town empty and nobody go stay der again. I go kover di town with wota from river.
20I go take am go where dead body dey. I go make una stay for dat undagroun wey empty and na dead body go bi una friend. Bikos of dis, una nor go ever kom out or stay with pipol wey dey alive again.
21I go use una as ezample wey go make pipol fear and dat go bi una end. Even if pipol find una, dem nor go ever si una again.” God wey get pawa don tok.