Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Ezekiel 21

:
Nigerian - pcm
1 God tell mi:
2 “Man pikin, make yu prish against di temple for Jerusalem, where pipol dey go woship. Warn Israel pipol
3 sey mi wey bi God sey, ‘I bi dia enemy. I go kill all of dem with my swod, both bad and good pipol.
4 I go kill both good and wiked pipol! I go use my swod take kut and kill pipol from nort go rish sout.
5 Den evribody for di world go know sey, mi wey bi God don draw my swod kom out and nor-tin go let mi put am back.’
6 “So man pikin, make yu kry well-well, bikos dem don break yor heart. Cry with pain for where evribody go for si yu.
7 If dem ask yu sey wetin make yu dey kry, make yu tell dem sey, na bikos of di news wey dey kom. Wen di news kom, fear go katch dem well-well; dia hand nor go fit move, dia mind go fail dem and dia leg go dey shake. Di time don kom and na naw.” God wey get pawa don tok.
8 God tell mi sey:
9 “Man pikin, tell di pipol wetin mi wey bi God dey tok:
10 “I dey sharp and klean swod to take kill pipol. I polish am and e dey shine like tonda lite. “Make my pipol dey happy? No! Dem nor fit, bikos dem don rijet all di warnin wey I give dem.
11 “I don polish my swod, bikos I won use am take kill. I go gi-am to di pesin wey go kill pipol.
12 So man pikin, make yu kry well-well, bikos I sharp dis swod to take kill my pipol and all di leaders for Israel. Dem go kill evribody, so make yu nak yor lap, bikos of dia pain.
13 “I dey test my pipol and if dem nor gri turn from sin kom meet mi, all dis tins go happen to dem.
14 “So make yu profesai and klap yor hands togeda. Di swod go attack and kill pipol again and again. E go kill my pipol well-well.
15 E dey make my pipol heart melt and doz wey go die go many well-well. My swod dey wait for all di gates, e dey shine well-well and e dey ready to kill.
16 Di swod go kut from rite and left! E go kut anytin wey e si.
17 Den, mi too go klap my hand and I nor go vex again. Mi, wey bi God, don tok.”
18 God kon tell mi:
19 “Man pikin, choose two road where Babilon king go pass kom with en swod. Di two road must start from di same kountry. Do sign post make yu put am for where di roads for start kon enter di kountry.
20 One road go show di king where e go pass rish Ammon town for Rabbah and di oda one go show am Judah road; di strong town wey dey Jerusalem.
21 Babilon king go stand near di sign post for where di road for start. E go shake di arrow, ask en juju kweshon kon shake di animal liver wey dem sakrifice, so dat e go know where e dey go.
22 Di arrow wey mark ‘Jerusalem’ dey for en rite hand! E go-go gada rams kon ready for war. Some ram go dey di gate and dem go build betta wall kon dig many whole.
23 Jerusalem pipol nor go bilive wetin dey happen, bikos of di agriment wey dem make. But na to make dem remember dia sins and to warn dem sey dem go katch dem go prison.”
24 So, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok. “I don si una sins and evribody don know how una bad rish. Una sins dey show for evritin wey una dey do. Naw, God go kondemn and give una to una enemies.
25 Una wey bi wiked and bad leaders for Israel! Di day wey God go ponish una, dey kom.”
26 Mi, God wey get pawa, don tok. “So, make una remove una crown and di fine skaf wey una tie for head. Una life nor go bi as e bi before. I go honor doz wey dey honbol kon disgrace doz wey dem bi dey honor!
27 I go skata una finish! Yes, I go skata una. I go skata di town finish. But dis one nor go happen until di pesin wey I choose kom; di pesin wey I choose sey make e skata di town. Na en I go give dis tin to.”
28 “Man pikin, make yu profesai. Tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell Ammon pipol wey dey curse Israel. Tell dem sey: ‘One swod dey ready to skata; swod wey dem polish to kill and e dey shine like tonda lite.
29 Di vishons wey una si nor bi true and wetin una sey go happen, na lie. Una dey evil and wiked well-well and una day dey kom; di day wey God go ponish una, den di swod go kut una neck komot.
30 So, make una karry una swod go back to where una from bring am, bikos I go judge una for where dem for kreate una.
31 Una go feel my vexnashon like hot fire. And I go give una to wiked men wey sabi distroy tins.
32 Dem go distroy una with fire. Una blood go flow for una own kountry and nobody go remember una again.’ God wey get pawa don tok.