Ezekiel 2pcm

1God tell mi sey, “Man pikin, stand up make I tok to yu”

2As God dey tok to mi, en Spirit enter my body kon karry mi stand and I kon listin well to evritin wey E dey tok.

3E sey, “Man pikin, I dey send yu go meet Israel pipol, bikos dem don turn from mi and still dey do bad tins, just as dia grand-grand papa do.

4Di pipol wey I dey send yu go meet so, dem sturbon well-well and dem nor dey respet mi. So I dey send yu go tell dem wetin mi, God wey get pawa dey tok.

5Weda dem listin to yu or not, dem go know sey one profet don kom meet dem.

6But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.

7Yu go tell dem evritin wey I sey make yu tok, weda dem listin or not, bikos I know sey dem sturbon well-well.

8Man pikin, make yu listin to wetin I go tell yu. Make yu nor sturbon like dem. Naw, open yor mout make yu chop wetin I go give yu.”

9So I si one hand dey kom meet mi and e hold one book wey dem fold.

10Di hand open di book and dem rite put for di two side. Na kry, mourning and pains dem rite put for di book.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 2.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.