Ezekiel 18pcm

1God kon tell mi again sey,

2“Israel pipol, dis word wey una dey always tok for dis land, na wetin e mean? Una dey sey, “ ‘Mama and papa dey chop grape wey don sawa, but na di shidren dey feel di sawa taste for dia mout.’ ”

3God sey, “As long as I bi di God wey nor dey die, una nor go tok dis kind tins again.

4Na mi get evribody life, even una papa and mama plus dia shidren life, na mi get am. Di pesin wey sin, na-im go die.

5“If to sey one man dey wey really dey good, raitious and honest;

6nor dey serve Israel pipol juju or chop food wey dem sakrifice give juju:

7Pesin wey nor dey play pipol wayo or tif from pipol. Anytin wey pesin gi-am, so dat e go borrow di pesin money, e dey riton am give di pesin; e dey give food to pipol wey dey hongry and doz wey dey naked, e dey give dem klot wear.

8E nor dey borrow pipol money so dat e go get gain. E nor dey do bad tins and e dey judge matter well.

9Pesin wey dey obey my kommand and keep my laws well. God wey get pawa sey, dat kind man dey raitious and e go get long life.

10“But if dis man get boy pikin wey dey kill and do all dis bad tins

11wey en papa nor dey do kon dey chop juju food and sleep with pipol wife?

12Or dey play poor pipol wayo; dey tif, dey keep wetin pesin gi-am, so dat e go borrow am money; dey follow sinnas go woship dia juju

13and dey borrow pipol money to make gain. E go fit live? No! E nor go live. E don do all dis bad tins, so e must die and e go blame ensef for en own deat.

14“But if e born pikin and di pikin si all di sins wey en papa dey do, but e nor follow am,

15or follow dem serve juju or chop food wey dem sakrifice give juju. Nor dey sleep with anoda man wife,

16opress or tif from pipol. Dey riton wetin pesin gi-am to take borrow money. Dey feed pipol wey dey hongry kon give klot to doz wey dey naked

17and nor gri do wiked tins or borrow pipol money to get gain. But dey keep my law and obey my kommand. E nor go die, bikos of en papa sin, but e go get long life.

18But for en papa wey play wayo, tif and dey wiked to evribody, go die bikos of di sins wey e kommit.

19“Naw, yu go ask sey: ‘Wetin make di pikin nor sofa for wetin e papa do?’ Di ansa na sey di pikin do wetin dey rite and good. E keep and obey my law, so e must really get long life.

20Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.

21“If wiked man stop to sin kon dey obey my law; dey do wetin dey rite and good, e nor go die, but e go get life.

22God go forgi-am all en sin and e go get life, bikos e do di rite tin.”

23God wey get pawa sey, “Yu tink sey I dey happy as wiked pipol dey die? No! I go like if dem turn from sin kom meet mi, so dat dem go get life.

24“But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.

25“Den una sey, ‘God dey play wayo.’ Naw, Israel pipol, make una ansa mi, ‘I dey play wayo?’

26Wen betta pesin stop to do good kon dey do bad tin, den e kon die, e die bikos of di sin and wiked tins wey e do.

27Na so too, wen wiked man stop to sin kon dey do wetin dey rite and good, e go save en life,

28bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.

29Una wey bi Israel pipol dey sey, ‘God dey play wayo.’ Una tink sey na wayo I dey do? Nor bi una dey do wayo?

30“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.

31Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?

32I nor wont make anybody die.” God wey get pawa sey, “Make una run from sin and una go get life.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 18.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.