Ezekiel 15pcm

1Den, God kon tell mi:

2“Man pikin, na how dem won take kompare vine with tree for forest?

3Yu fit use di vine do anytin? Yu fit even hang sometin on-top am?

4E only dey yuzful as firewood. Even if di wood nor burn skata finish for di fire, yu still fit use am do anytin?

5E nor bin dey yuzful even before dem burn am, so na naw wey fire don burn am, e won dey yuzful?”

6Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy

7and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God.

8Dem nor dey respet mi, so I go turn dia land to desert.” God wey get pawa don tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 15.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.