Exodus 31pcm

1God tell Moses,

2“Si, I don koll Bezalel wey bi Uri pikin wey en grand-papa kom from Hur tribe for Judah.

3I don put my Spirit inside am, so dat e go know how to do difren work.

4E know how to design some fine tins with gold, silva and bronze and

5how to kut wood and set stones. E still know how to do kraft work well-well.

6I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do:

7di Tabanako; di Testimony Box; di atonement box kover wey dey on-top; all di tins wey dey inside di Tabanako;

8di tabol and di tins wey dey on-top; di pure lampstand with all di tins wey hold am, di incense altar,

9di burnt ofrin altar with all di tins wey e dey use; di basin with en stand;

10di garment wey dem weave; di holy garment wey Aaron and en sons go wear to take serve as priest;

11di anointin oil and di sweet incense for di holy place. Di men must make evritin, just as I kommand yu.”

12God kon tell Moses,

13“Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una.

14Una must keep di Sabat Day, bikos e dey holy to una. Anybody wey work for dat days, must die.

15Una get six days to work, but di sevent day wey bi Sabat Day, na to rest, bikos e dey holy to God; anybody wey work for di sevent day, must die.

16Israel pipol must keep di Sabat Day and obey am from one generashon go rish anoda. Dis kovenant go last forever.

17Na sign between mi and Israel pipol forever. Bikos God use six days take kreate di heaven and di eart and E rest for di sevent day.’ ”

18Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Exodus 31.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.