Exodus 25pcm

1God kon tell Moses:

2“Make yu tell Israel pipol make dem bring ofrin kon give mi. Yu go kollect di ofrin wey pipol go give from dia heart.

3Na dis kind ofrin yu go kollect from dem: gold, silva, bronze,

4fine linen, blue, purpol and red wool; klot wey dem make with goat hair,

5ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood,

6oil for di lite, spices for di anointin oil and for di incense wey get betta smell.

7Onyx stones and oda tins wey dem go put for di priest garment and for di chest side.

8Make dem build house for mi, so dat I go fit follow una stay.

9Yu must make am with all di tins wey dem go put inside, just as I show yu.”

10“Make dem build box with akasia wood wey long rish three fit nine inches and e go wide and high rish three fit.

11Make dem kover inside and outside di box with pure gold.

12Yu go make four gold ring kon put am for di four leg; two-two ring for each side.

13Make some pole with akasia wood, kover am with gold

14kon take di poles pass inside di rings wey dey di box side, so dat dem go fit use dem karry di box.

15Di poles must dey inside di rings for di box; dem must nor take dem komot.

16Di two small flat stones wey I go rite my kommandment put, yu go put dem inside di box.

17“Make yu make one kover with pure gold; e go long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.

18Yu go use gold wey dem melt take make two tins wey bi like angel wey get plenty feada kon put dem for di two korna for di box kover.

19One among di angels wey dem make, go dey one end and di sekond one go dey di oda end.

20Di angels go spread dia feada kon kover di box and di angels go face each oda dey look di box.

21Yu go put di box kover on-top di box, den kon put di flat stones wey I go give yu, inside.

22Den I go meet yu for der and from di box kover; between di two angels wey kover di box wey di kommandment dey, I go tell yu all di tins wey yu go kommand Israel pipol.

23“Yu go use akasia wood take make one tabol; e go long rish three fit; wide like one fit six inches and e go high rish two fit three inches.

24Yu go design am with pure gold.

25Yu go make rim wey wide and round rish three inches kon do borda round di rim.

26Yu go use gold make four rings kon put dem for di four korna wey di legs dey.

27Di rings go dey near di rim and e go bi di poles wey dem go take dey karry di tabol.

28Yu go use akasia wood take make all di poles kon design dem with gold, so dat dem go fit karry di tabol with dem.

29Yu go make some plate, cup, jar and bowl wey dem go dey use for di wine ofrin. All dis tins, na pure gold yu go take make dem.

30Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.

31“Yu go make one lampstand with gold. Na gold wey dem melt yu go take make di bottom, en leg, cups, di small-small seeds and di flowers go bi di same with am.

32Di lampstand go get six side: from en leg, three go dey one side and anoda three go dey di oda side.

33Three cup wey dem shape like almond flower wey get small-small seeds, go dey di next branches and na di same tin e go bi for di six branches wey go kom out from di lampstand.

34And for di lampstand, e get four cup wey dia shape resemble almond flower wey get small-small seeds and shine-shine.

35One of di small-small seed go dey under all di six branches wey kom out from di lampstand.

36Na di same pure gold wey yu melt, yu go take make dia small-small seed, branches and lampstand.

37Yu go make seven lamp for di lampstand kon stand am, so dat e go give lite to di aria for en front.

38Yu go use pure gold take make di lampstand korna and di tray.

39Make yu use about seventy-five pound for pure gold take make di lampstand and di oda tins.

40“Naw, make sure sey yu make dem, just as I show yu for di mountin.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Exodus 25.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.