1Leta wen di king nor dey vex again, e kon dey tink about wetin Vashti do and wetin e kommand about am.
2So some among di king advise wey dey klose to am kon sey, “E go good make wi go find one fine girl wey bi virgin for yu?
3Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.
4Den yu go take di girl wey yu like pass kon make am kween to replace Vashti.”
5E get one Jew wey dey stay for Shushan and en name na Mordekai wey bi Jair pikin; e kom from Kish and Shimei family for Benjamin tribe.
6Wen King Nebukadnezzar for Babilon karry King Jehoiakim for Judah from Jerusalem go prison with oda pipol, Mordekai family dey join dem.
7Mordekai get one fine kousin wey en name na Estha and en Hibru name na Hadassa. Wen di girl papa and mama die, Mordekai take and train am as en own pikin.
8Wen di king kommand make dem bring girls kom Shushan, Estha dey join dem too. Estha sef dey di royal palis and na Hegai dey kare for all di king wimen.
9Hegai like Estha bikos of wetin e dey do and how e dey do tins. E know waste time before e sey make dem dey trit Estha well both for wetin e wont and food wey e go chop. E give Estha di best place to stay kon choose seven girls from di royal palis wey go dey attend to am.
10Naw, just as Mordekai tok, Estha nor tell anybody sey e bi Jew.
11Evriday, Mordekai dey go meet Estha, so dat e go know how tins bi with am.
12Dem trit di girls well for one year, dem massage dem with myrrh oil for six monts and balsam oil for di oda six monts. Afta, dem kon dey take each girl go meet di king.
13Wen e rish time for any of di girls to go meet di king, any klot or tin wey di girl ask for, dem dey gi-am.
14E go-go der for evening kon kom back for morning, den dem go take am go meet Shaashgaz wey dey kare for di king girl-friends. Di girl nor go-go meet di king again, unless di king like am kon ask of en name.
15Time kon rish for Estha to go meet di king. Estha na Abihail pikin and Mordekai kousin and anybody wey si am, dey like am. Wen e turn rish, e wear wetin Hegai wey dey kare for dem sey make e wear.
16So for di sevent year wen King Zazes dey rule, for di tent mont wey bi Tebet mont, dem bring Estha kom meet King Zazes for di royal palis.
17Di king like am pass any of di oda girls and Estha kon win di king heart. E put di royal crown for Estha head kon make am kween take replace Vashti.
18Den di king do big party kon invite all en ofisas to take honor Estha. E give holy day to evribody for en kingdom kon give dem betta-betta gifts.
19For di time wen dem dey karry di oda wimen go where dem go stay, na Mordekai dey guide di palis gate.
20Estha still nor let di king know sey en bi Jew. Mordekai don tell am sey make e nor tell anybody and e obey am, just as e dey always obey am.
21One day wen Mordekai dey work for di palis gate, Bigtan and Teres wey bi ofisas wey dey guide di king door-mot kon dey vex and plan to kill King Zazes.
22Wen Mordekai know dia plan, e kon go tell Kween Estha, den di kween tell di king wetin Mordekai tok.
23Dem kon shek well and dem fine out sey wetin Mordekai tok, na true, so dem kon hang di two men. Dem rite all wetin happen so for di king rekord book.