Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Deuteronomy 33

:
Nigerian - pcm
1 Dis na di blessing wey Moses, God savant bless Israel pipol before e die:
2 “God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.
3 Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem.
4 Moses give us God kommand, di special place wey E keep for en pipol, Israel.
5 Na God bi king for Israel wen all di leader among di pipol go gada go meet kon gada all di tribe for Israel as one.”
6 Moses pray for Reuben tribe sey: “Reuben tribe go live and dem nor go die, even doh dem nor plenty.”
7 Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make Yu hear Judah pipol kry kon bring dem togeda as one. Make Yu give dem pawa to take fight and win dia enemies!”
8 Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside.
9 Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant.
10 Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar.
11 Make wi bless God strent and di work wey E don do; bikos E kill di enemies lion, so dat dem nor go fit raiz at-all!”
12 Moses pray for Benjamin tribe sey: “God love Benjamin pipol and dem dey save under am. E dey gada dem from evry side, so dat nor-tin go do dem.”
13 Moses pray for Josef tribe sey: “Make God bless una land with rain and with wota wey dey kom from under di groun.
14 Make betta-betta fruit wey dey grow under di sun dey una land and di fruit for di sizin go bi una own.
15 Make betta fruits kover una hills and mountins.
16 Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.
17 Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”
18 Moses pray for Zebulun and Issakar tribe sey: “Zebulun pipol go prosper as dem dey travel. Make Issakar pipol prosper for dia house.
19 Dem invite strenjas kon dia mountin kon offa di rite sakrifice for der. Dem get dia money from di sea and di wotaside.”
20 Moses pray for Gad tribe sey: “God go bless una wey make en land wide! Gad pipol bi like lion wey won tear pesin hand or head komot from en body.
21 Gad pipol take di best land for diasef; dem give dem di leadership. Wen Israel pipol leaders don gada, na Gad pipol dey first obey God kommand and rules for Israel.”
22 Moses pray for Dan tribe sey: “Dan pipol bi like yong lion wey dey kom out from Bashan.”
23 Moses pray for Naftali tribe sey: “Naftali pipol, favor go follow una and God don bless una well-well; make una kollect di west and sout as una own.”
24 Moses pray for Asher tribe sey: “Make God bless Asher pipol pass evry oda sons; make en brodas karry am high and Asher pipol go dey wosh dia own legs with olive oil.
25 Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.
26 Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.
27 Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!
28 So Israel pipol go stay for peace, Jakob pipol go prosper for di land wey get food and wine and dew go drop from heaven.
29 Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”