1King Nebukadnezzar build one gold image. E tall rish ninty fit and na so too e wide rish nine fit. Di king put di image for Dura aria for Babilon.
2Di king sey, doz wey bi offisa, prince, govnor, judge, wise men, kounselor, treasurer, magistrate and doz wey get pawa, make dem koll dem kom di image dedikashon.
3So all of dem gada kom di king image dedikashon. Dem stand for di image front.
4Den di pesin wey dey announce kon shaut sey: “Pipol from all nashon, tribe and language, make una listin to mi!
5Wen una hear trumpet sound wen dem dey play di horn, lyre, jita, zita, harp with di oda instrument and di song, evribody must bow kon woship di image wey di king use gold make.
6Anybody wey nor gri bow woship di gold image, dem go trow am inside hot fire.”
7So, as dem hear music and all di oda instrument sound, di pipol kon bow woship di gold image wey Nebukadnezzar make.
8For dat time, some Babilon pipol kon go ripot di Jew dem give di king.
9So, dem tell King Nebukadnezzar, “Awa king, make yu live forever!
10Yu orda sey, wons wi hear di music dey play, evribody must bow kon woship di gold image
11and anybody wey nor gri bow woship di image, dem go trow am inside fire.
12E get some Jew wey yu put as oga for some aria for Babilon, dem nor gri bow woship di image and dia name na: Shadrak, Meshak and Abednego.”
13Wen di king hear wetin dem tok, e vex kon sey make dem go bring di three men kom en front.
14Wen Shadrak, Meshak and Abednego kom, di king ask dem, “Na true sey una nor gri woship or bow to di image wey I make?
15So naw, if una don ready, wons una hear di trumpet, di horn, lyre, jita, harp and all di oda instrument sound, make una bow woship di image. If una nor gri, na wons I go trow una enter di fire. Abi una tink sey any god dey wey go save una?”
16Shadrak, Meshak and Abednego ansa King Nebukadnezzar, “Wi nor fit ansa yu for dis matter.
17If di God wey wi dey serve dey alive, E go kom save us from yor hand and from di hot fire.
18But even if E nor save us, wi wont make yu know sey, wi nor go serve or woship yor gold image.”
19King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.
20E sey make strong sojas tie Shadrak, Meshak and Abednego kon trow dem inside di hot fire.
21Dem tie di three men, wear dem klot, nika and priest kap kon trow dem inside di hot fire.
22Bikos di king kommand too dey kwik and di fire dey hot pass normal, di men wey go trow dem for inside di fire die too, bikos of di way di fire dey hot.
23Shadrak, Meshak and Abednego wey dem tie dia hand and leg well-well, fall enter di fire centre.
24King Nebukadnezzar get up at wons kon ask, “Shebi na three pipol wi trow inside di fire?” Dem ansa di king, “Yes.”
25Di king kon tell dem, “But I dey si anoda pesin for der, dem nor tie am and e just dey waka round di fire! Nor-tin don happen to dem! And di nomba four pesin bi like angel!”
26Nebukadnezzar waka near di fire door kon koll dem, “Shadrak, Meshak and Abednego; God Almighty savants, make una kom out!” Den Shadrak, Meshak and Abednego kon waka komot from di hot fire.
27Di offisa, wise men, govnor and ministers wey dey serve di king, gada kon si sey di men wey dem trow for di fire, nor wound at-all! Nor-tin even tosh dia hair or sey dia klot burn. Even di fire sef nor smell for dia body!
28Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’
29Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”
30So Nebukadnezzar kon promote Shadrak, Meshak and Abednego.