1For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.
2God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
3Den di king kommand Ashpenaz wey dey guide di kourt sey make e choose some Israel men wey kom from royal house and from betta family:
4yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.
5Di king still orda sey make dem give dem di same food and wine wey en and di oda pipol dey chop and drink evriday. E sey dem go train dem for three years and afta di three years, dem go kom serve di king.
6Di pipol wey dem choose from Judah na: Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya.
7But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
8But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.
9So God kon make Ashpenaz mind soft and e gri with wetin Daniel tell am.
10So e tell Daniel, “I dey fear my masta di king. Na-im tok di kind food wey una go chop and wine wey una go drink; wot of if e sey yu dey tin and di oda yong men dey fat! Wetin I go tell am?
11Den Daniel go meet di pesin wey Ashpenaz sey make e dey guide en, Hananaya, Mishael and Azaraya kon tell am:
12Abeg make yu test yor savants for ten days. Just give us vegitabol make wi chop and wota make wi dey drink.
13Afta di ten days, make yu kompare us with di odas wey dey chop and drink di king food and wota; den yu go judge us with wetin yu si.”
14Di pesin wey dey guide dem so kon gri with wetin e tok and e test dem for ten days.
15Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.
16So di pesin wey dey guide dem kon remove di royal food and wine wey di king sey make dem chop, den dem kontinue to chop dia vegitabol and drink wota.
17God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.
18Afta three years, Ashpenaz kon take all di yong men go meet King Nebukadnezzar.
19Den di king follow dem tok. E nor si anybody wey bi like Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya. So dem kon bi memba for di king kourt.
20Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
21Daniel stay for di royal house until di first year wen King Cyrus start to rule.