Bible

Focus

On Your Ministry and Not Your Media

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Amos 8

:
Nigerian - pcm
1 Dis na wetin Oga God show bi: For di vishon, I si one basket wey fruit full.
2 God kon ask mi, “Amos, na wetin yu dey si?” I ansa, “Na basket wey fruit full.” Den God tell mi, “Di end don kom for my pipol, Israel. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
3 “For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
4 Make una listin, una wey dey opress and distroy poor pipol wey dey di town.
5 Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.
6 Wi go buy poor pipol with money and doz wey nor get anytin, wi go buy dem with sandals kon even sell awa korn kanda too.”
7 Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.
8 So di eart go shake and evribody for di land, go sofa. Di whole kountry go shake; dem go raiz-up kon fall like Nile River for Egypt.
9 For dat day, I go make di sun vanish for aftanoon and darkness go dey di eart for day time.” Oga God don tok.
10 “I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.
11 Di time dey kom wen I go send honga kom di land. Pipol go dey hongry, but nor bi for food. Dem go dey thirsty, but nor bi bikos of wota; instead dem go dey hongry to hear God message.” Oga God don tok.
12 “Pipol go dey waka up-and-down from Dead Sea go Mediterranean Sea kon from nort go east. Dem go dey find God message for evriwhere, but dem nor go si am.
13 For dat day, even strong men and wimen go dey hongry to hear God word.
14 And doz wey swear with dat yuzles Samaria juju or with Dan juju name and vow with Beersheba juju, go fall for groun and dem nor go raiz-up again.”