2 Kings 17pcm

1For twelf years wen King Ahaz dey rule Judah, Elah pikin, Hoshea kon bi king for Israel. E rule from Samaria for nine years.

2E nor gri obey God, but en own nor bad rish di tins wey di oda kings wey dey before am, do.

3King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.

4Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.

5Assyria king and en sojas mash go attack Samaria kon seize am for three years.

6For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.

7Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga dia God; di Pesin wey save dem from Egypt pipol and King Fero hand. Dem dey woship oda gods;

8di kountries wey God porshu bikos of Israel pipol, dem dey follow dem serve dia juju kon dey do all di bad-bad tins wey Israel kings do before.

9Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well.

10Dem build image and Asherah juju for evry high place and under evry green tree.

11Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.

12Even as God kommand dem rish, dem still dey woship dia yeye juju.

13God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”

14But una nor gri listin, instead una dey show strong head like dia grand-grand papa wey nor trust di Oga dia God.

15Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.

16Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.

17Dem offa dia shidren as sakrifice and dey do majik and oda bad-bad tins. Dem decide to dey do bad tins for God present and na dis make God dey vex.

18So, bikos God dey vex for Israel pipol, E kon rijet dem; but Judah tribe still dey obey am.

19Leta, Judah pipol nor gri obey wetin di Oga dia God tok; dem kon dey do like Israel pipol.

20So God rijet all Jakob shidren-shidren; E disgrace and give dem to tif, until E komot all of dem from en present.

21E remove Israel pipol from David generashon and Nebat pikin, Jeroboam kon bi dia king. Jeroboam drive Israel pipol komot from God present kon enkourage dem to sin well-well.

22Israel pipol kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin and dem nor gri turn kom meet God.

23So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.

24Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.

25Wen dem first rish der, dem nor gri woship God. So God kon send lion go meet and kill some of dem.

26Dem kon tell Assyria king wetin happen sey, “Di pipol wey yu bring kom dis town, nor know wetin God wont for di town, so E don send lion kom kill dem. Di lion dey kill pipol, bikos dem nor know wetin God wont for di land.”

27So Assyria king ansa, “Make una go bring one among di priest wey wi take from der kom. E go stay der kon tish us wetin God wont for di land.”

28So di priest wey dem bin karry komot Samaria kon go back go stay for Bethel. E tish dem how to woship God.

29But each tribe make dia own gods kon put dem for shrine for di high place wey Samaria pipol make. Each tribe do like dis for di town wey dem dey.

30Di pipol wey kom from Babilon make Sukkot-Benot; while di ones wey kom from Kut, make Nergal and doz wey kom from Hamat, make Ashima;

31di ones wey kom form Avva, make Nibhaz and Tartak; while doz wey kom form Sefarvaim dey burn dia sons for fire as sakrifice to Adrammelek and Anammelek wey bi Sefarvaim gods.

32Bikos dem dey fear God well-well, dem kon pick some from dia own pipol wey go work as priest for di shrine wey dey di high place dem.

33For di same time, dem dey woship God and serve dia gods, just as dem dey do from where dem from kom.

34Till today, dem still dey woship dia gods. Dem stop to woship God or obey en rules, kommand and laws wey E give Jakob shidren-shidren.

35God enter agriment with Israel pipol sey, “Una must nor woship anoda god. Make una nor bow, serve or offa sakrifice to dem.

36Instead una must woship mi wey bring una kom out from Egypt with my great pawa. Una go bow and offa sakrifice to only mi.

37Una must always dey obey my rules, laws and di kommandment wey I rite for una. Una must nor woship anoda god.

38Una must nor forget di agriment wey I make with una and make una nor woship anoda god.

39Make una woship di Oga wey bi una God; den E go save una from all una enemies.”

40But dem nor listin; instead dem do as dem dey do before.

41Even doh dis pipol dey woship God, dem still dey serve juju. So till today, dia shidren and shidren-shidren dey bihave like dem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Kings 17.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.