2 Chronicles 8pcm

1Twenty years afta Solomon don build God Temple and en royal palis,

2e ribuild di town wey Hiram gi-am kon put Israel pipol for der.

3E go Hamat-Zoba kon seize am.

4E build Tadmor for di wildaness and all di towns wey dem for dey keep tins wey E build for Hamat.

5Di Uppa Bet-Horon and di Lowa Bet-Horon, Solomon make di towns strong with walls and iron gates

6and e build Baalat. Na en get all di towns where dem for dey keep tins, plus di town where dem keep shariot and ordinary horse put. E build anytin wey e wont for Jerusalem, Lebanon and evriwhere for en kingdom.

7For dis time, many pipol wey nor bi Israel pipol still dey di land afta Joshua don win Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol.

8Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today.

9Solomon nor give Israel pipol dis kind work, bikos na dem bi sojas, ofisas, doz wey dey ride shariot and doz wey dey kommand di sojas.

10Dis pipol so, dey work for Solomon as supavisor; dem bi 250 wey dey supavise dis pipol.

11Solomon karry Fero dota from David Town go di palis wey e build for am kon sey, “My wife nor go stay for di palis wey bi Israel king, David own, bikos di place where di Kovenant Box enter, dey holy.”

12Den Solomon offa sakrifice give God on-top di altar wey e build for di temple front.

13E do evritin for di sakrifice, just as Moses tok about Sabat Day, New Moon festival and di three celebrashon wey dem dey do wey bi: Bread Wey No Get Yist Feast, Di Week Feast and Di Shelta Feast.

14As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok.

15Dem do evritin wey di king orda koncerning di priest, Levi pipol and di propaty dem.

16All di work wey Solomon sey make dem do, rite from di day wey dem lay di foundashon for God Temple until dem finish am, dem do all komplete. So, dem kon finish all di work for God Temple.

17Den Solomon go Ezion-Geber, before e kon go Elat wey dey Edom wotaside.

18Hiram send sheep and some pipol wey sabi kontrol sheep go meet am. Men wey know how to drive for sea. Dem drive with Solomon men go rish Ofir kon take 450 gold from der, den dem bring am kon give King Solomon.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Chronicles 8.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.