2 Chronicles 26pcm

1All di pipol for Judah kon make Uzzaya king afta en papa, Amazaya don die.

2Afta Amazaya die, King Uzzaya ribuild Elat for Judah pipol.

3Uzzaya na sixteen years wen e start to rule and e rule for fifty-two years from Jerusalem. En mama name na Jekolaya wey kom from Jerusalem.

4E obey God, just as en papa King Amazaya bin do.

5E follow God wen Zekaraya dey alive, bikos e tish am how to honor God. God make am prosper as e dey follow am.

6Uzzaya attack Filistia pipol kon skata Gat, Jabneh and Ashdod wall. E build towns for Ashdod and all Filistia aria.

7God help am fight Filistia, Arab and Meun pipol wey dey Gur Baal.

8Ammon pipol dey respet Uzzaya well-well, so e kon get pawa and e rule go rish Egypt side.

9King Uzzaya build towas for Jerusalem near di Korna Gate, di Valley Gate and for di wall korna, den e fence dem round.

10E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.

11King Uzzaya get many sojas wey dem train to fight war; dem arrange di sojas for difren group, just as Jeiel wey dey rite and Maaseaya wey bi di ofisas, wen Hananaya bi di sojas oga, do am.

12All di family leaders wey lead sojas, na 2,600.

13Dem dey kommand 307,500 sojas wey get skill and fit fight and dem ready to fight for dia king.

14King Uzzaya give all di sojas shield, spears, helmet, breast-plates, bows and katapault stones.

15E make war machine for Jerusalem wey dem take dey shot arrow with big stones from di towas and di wall kornas. E get pawa well-well, bikos pipol dey support am.

16E kon use en pawa take distroy ensef, bikos e nor gri obey God again. E enter God Temple kon offa incense for di altar.

17Priest Zabud and di oda eighty priest wey get mind follow am enter di temple.

18Dem go meet King Uzzaya kon tell am, “E nor good make yu offa incense give God by yorsef, bikos dat na di work wey priests dey do and na Aaron shidren-shidren dem anoint to dey offa incense. Make yu komot from God house, bikos yu don disobey and nor gri respet am!”

19So King Uzzaya kon dey vex and e hold di incense plate for hand. As e dey shaut for di priests, one kind skin diziz kom out for en fore head for di temple near di incense altar.

20Wen Priest Zabud and di oda priests look am well, dem kon si di diziz for en fore head. So di priests hurry karry am komot, bikos dem si sey God don ponish am.

21Dat diziz sofa King Uzzaya until di day wen e die. Dem separate am from pipol, bikos of di diziz and dem nor let am enter God Temple again. En pikin Jotam kon take-ova as king.

22Di remainin tin wey Uzzaya do wen e dey rule, dem rite dem put for Profet Isaya wey bi Amos pikin book.

23King Uzzaya die and dem beri am near en grand-grand papa for where dem dey beri kings. (Dis na bikos e get skin diziz.) En pikin Jotam kon take-ova as king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Chronicles 26.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.