2 Chronicles 10pcm

1Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.

2Nebat pikin, Jeroboam wey run from Solomon go hide for Egypt, still dey stay der wen e hear dis tin.

3Dem kon send pesin go koll Jeroboam kom and all of dem go meet Rehoboam kon tell am,

4“Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon komot dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”

5Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.

6King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon sey, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”

7Dem ansa am, “If yu wont make dis pipol serve yu well; give dem ansa wey dem go like and dem go use all dia heart serve yu forever.”

8But King Rehoboam nor listin to dem, instead e go ask di yong men wey bi en mate,

9“Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”

10Dem ansa, “Make yu tell dem, ‘I hard pass my papa, Solomon!’

11Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”

12Afta three days, Jeroboam and di pipol go meet King Rehoboam, just as e tell dem.

13Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just

14as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work hard well-well. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”

15Dis na how God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.

16Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol bigin argue among diasef

17kon waka leave Rehoboam make e bi king to only doz wey dey Judah aria.

18So King Rehoboam send Adoniram wey bi di workers oga go meet Israel pipol, but dem stone am die and wen King Rehoboam hear wetin happen, e kwik-kwik enter en shariot kon run go Jerusalem.

19And na since den Israel pipol for nort bigin fight against David kingdom.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Chronicles 10.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.