2 Samuel 22
1 David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:
2 “Na di Oga awa God dey protet mi; Na-im dey diliver mi.
3 Na God dey protet and save mi. Na-im bi my shield and E dey defend mi. E dey protet and save mi from danger.
4 I go praiz God, bikos wen ever I koll am, E dey save mi from my enemies!
5 Deat dey round mi; e bi like sey dem go soon distroy mi.
6 Deat really dey around mi and grave set trap for mi.
7 Wen I dey trobol, I koll Oga God; I koll my God make E help mi. E hear my vois for en temple kon listin and help mi wen I dey kry.
8 Den di eart bigin shake dey fear, di sky foundashon bigin shake too, bikos God bin dey vex!
9 Smoke dey kom out from en nose, while fire and shako dey kom out from en mout.
10 E tear di sky open kon kom down with one black kloud for en leg.
11 E dey fly with en shariot for heaven; E dey travel with di wind.
12 E kover ensef with darkness and tick kloud wey wota full dey round am.
13 Shako with fire dey kom out for en front.
14 Oga God dey bring tonda from di sky and evritin dey hear wen God wey get pawa dey tok.
15 E shot en arrow take skata en enemies. E use strong lite take make dem run.
16 Di river dry finish and di eart foundashon kon open so God nor keep silent and E kon shaut for en enemies with vexnashon.
17 God kom down from heaven kon hold mi. E draw mi komot from di wota wey deep well-well.
18 E save mi from my strong enemies and all di pipol wey hate mi, bikos dem too strong for mi.
19 Wen I dey trobol, dem attack mi, but God protet mi.
20 Bikos E dey happy with mi, E help mi wen I dey trobol kon save mi.
21 God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E bless mi, bikos I dey innocent.
22 I don obey God law; I neva turn from my God before.
23 I don keep all en laws; I neva disobey en kommand.
24 E know sey I nor get fault and I nor dey do bad tins.
25 So E reward mi, bikos I dey do wetin dey rite, bikos E know sey I dey innocent.
26 My Oga God, Yu dey faithful to doz wey dey faithful to Yu and Yu dey good to pipol wey dey good.
27 Yu dey pure to doz wey dey pure, but Yu show wikedness to wiked pipol.
28 Yu dey save pipol wey dey honbol, but Yu dey honbol pipol wey dey proud.
29 Oga God! Na Yu bi my lite; Yu don remove my darkness.
30 Yu give mi pawa take attack my enemies kon ovakom dem.
31 Di tins wey dis God dey do, dey pafet. Make wi trust en words! E dey kover pipol wey wont make E protet dem.
32 Na di Oga bi God and na only God dey defend us.
33 Na inside God I hide put; E dey make my road save.
34 E make my foot dey save like deer kon keep mi save for di mountin.
35 E dey train mi for war, so dat I go use di bow wey strong well-well.
36 My Oga God! Yu protet and save mi; Yu don make mi great.
37 Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi and I nor fall.
38 I porshu and defeat my enemies; I nor stop till I distroy dem finish.
39 I nak dem fall and dem nor fit stand again, bikos I defeat dem.
40 Yu give mi pawa for war and viktory ova my enemies.
41 Yu dey make my enemies run from mi and I distroy doz wey hate mi.
42 Dem dey look for help, but nobody dey to save dem. Dem koll God, but E nor ansa dem.
43 I skata and turn dem to san. I dey waka on-top dem like mud for street.
44 Yu save mi from my own pipol wey fight mi kon make mi dey always rule di nashons and even pipol wey I nor know, dey under mi.
45 Doz wey kom from anoda land dey bow for mi and wen dem si mi, dem dey obey.
46 Anywhere wey dem hide put, dem dey run komot der, bikos dem dey fear.
47 God go dey forever! Make wi praiz di Pesin wey dey defend mi! Make una tok how God wey save mi strong rish!
48 E give mi viktory ova my enemies kon put di nashons under mi.
49 My Oga God! Yu save mi from my enemies kon give mi viktory and protet mi from wiked men.
50 So, I dey praiz Yu among all di nashon; I go sing praiz Yu.
51 God dey give en king great viktory. E dey always show love to di pesin wey E choose and na mi, David with my shidren-shidren go rule forever.”