1 Peter 4pcm

1Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again,

2bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont.

3Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju.

4Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again.

5For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem.

6Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement.

7Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.

8As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.

9Make una welkom pipol for una house without komplain.

10God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.

11Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!

12My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen.

13Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.

14If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life.

15But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.

16But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name.

17Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God?

18If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God.

19So if yu dey sofa as God wont am, make yu trust God wey kreate yu and E nor go ever fail yu.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Peter 4.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.