1 Kings 5pcm

1King Hiram for Tyre, na David friend, so wen e hear sey Solomon don bi king afta en papa, David, e kon send some pipol go meet am.

2Solomon send dis message go meet King Hiram,

3“Yu know sey, bikos of di war wey David my papa dey fight with all en enemies, e nor fit build temple where dem go for dey woship di Oga wey bi en God, until God gi-am viktory ova all en enemies.

4But naw, God don give mi peace for evriwhere. I nor get any enemy and I nor dey fear sey pipol go won attack mi.

5God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.

6So make yu send yor men go Lebanon go kut cedar wood for mi. My men go work with dem and I go pay yor men any prize wey yu tok. Yu know sey my men nor sabi kut trees like yor men.”

7Hiram happy wen dem gi-am Solomon message so e kon sey, “Make wi praiz God today wey give David dat kind pikin as king ova dis strong nashon!”

8Den Hiram send Solomon dis message sey, “Dem don give mi yor message and I ready to do wetin yu wont. I go provide di cedar wood and di pine trees wey yu wont.

9My men go bring di woods from Lebanon kom di river kon tie dem togeda and float dem kom di place wey yu choose. Den, my men go luz dem and yor men go karry dem go. But I go like make yu give my men food.”

10So Hiram give Solomon all di cedar wood and pine tree wey e wont

11and Solomon dey give Hiram 100,000 bucket for wheat and 110,000 gallons for pure olive oil evry year make e take feed en men.

12God keep en promise kon give Solomon wisdom. Peace dey between Hiram and Solomon and dem make agriment with diasef.

13Solomon bring 30,000 men from evriwhere for Israel make dem do di work

14and e sey make Adoniram kare for dem. E divide dem into three group. 10,000 men dey one group and each group dey spend one mont for Lebanon and two monts for house.

15Solomon still get 80,000 men for di mountin side wey dey kut stones and 70,000 men wey dey karry di stones.

16E still put 3,300 men for front make dem dey supavise di work.

17Just as Solomon tok, dem kon kut fine big stones wey dem go take build di temple foundashon.

18So, King Solomon men, King Hiram men and di men from Gebal town kon make di stones and timba wey dem go take build di temple.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 5.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.