1 Kings 12pcm

1Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.

2Wen Nebat pikin, Jeroboam hear di news, e still dey stay Egypt, di place wey e run go hide bikos of Solomon.

3Dem kon send pipol go koll Jeroboam kom and all of dem go meet Rehoboam kon tell am,

4“Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon remove dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”

5Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.

6King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”

7Dem ansa am, “If yu wont make dis pipol serve yu well; give dem ansa wey dem go like and dem go use all dia heart take serve yu forever.”

8King Rehoboam nor listin to dem, so e go ask di yong men wey bi en mate,

9“Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”

10Dem ansa, “Yu go tell dem, ‘I wiked and hard pass my papa, Solomon!’

11Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard pass as e bi before. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”

12Afta three days, Jeroboam and di pipol go meet King Rehoboam, just as e tell dem.

13Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just

14as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work, hard pass as e bi before. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”

15Na so God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.

16Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol kon bigin kworel among demsef

17as dem dey waka leave Rehoboam make e bi king to only doz wey dey Judah aria.

18So King Rehoboam send Adoniram wey bi di workers oga sey, make e go meet Israel pipol, but dem stone am die and as King Rehoboam hear wetin happen, e kwik-kwik enter en shariot kon run go Jerusalem.

19And na since den Israel pipol for nort, bigin fight against David kingdom.

20Wen all Israel Pipol hear sey Jeroboam don kom back from Egypt, dem invite am kon make am king for Israel. So, na only Judah tribe kon dey obey David shidren-shidren.

21Wen Rehoboam rish Jerusalem, e koll 180,000 strong sojas from Judah and Benjamin tribe sey make dem go fight Israel tribe for nort.

22But God tell Profet Shemaya,

23“Make yu go tell Rehoboam, Judah and Benjamin pipol sey:

24‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house.

25King Jeroboam for Israel, guide and build wall round Shekem town, wey dey di hill kountry for Efraim kon stay der for sometaim. Den e komot for der kon go build and guide Penuel town.

26E tell ensef, “As tins bi naw, if my pipol go Jerusalem go give God sakrifice for di temple wey dey der,

27dem go bigin respet Rehoboam for Judah, den dem go won kon kill mi.”

28Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”

29E put one of di gold melu for Bethel and di oda one, for Dan.

30So di pipol kon sin as dem dey woship di melu wey dey Bethel and Dan.

31King Jeroboam still build one place on-top di hill sey make pipol dey kom woship for der and e choose priest from family wey nor kom from Levi tribe.

32King Jeroboam still dey do one feast for di fifteent day for evry eight mont, just like di feast for Judah. E make sakrifice for di gold melu on-top di altar wey e make for Bethel kon put priest for di woship place wey e build.

33And for evry fifteent day for di eight mont; di day wey en ensef choose; e dey go di altar for Bethel go do sakrifice to celebrate di feast, wey e dey do for Israel pipol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 12.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.