1 Kings 10pcm

1Wen di kween for Sheba hear about di wonderful tins wey Solomon dey do, e kon travel go Jerusalem go test am with hard-hard kweshon.

2E karry plenty pipol follow body kon load spices, jewels and plenty gold full en kamels. Wen di kween si Solomon, e kon ask am all di kweshon wey dey en mind.

3King Solomon ansa all di kweshon and e nor get any one wey hard am to ansa.

4Sheba kween know sey King Solomon get wisdom and e si di palis wey e build;

5di food wey dem serve for di tabol; di house wey en ofisas dey stay; how en workers dey do and di uniform wey dem wear; di savants wey dey serve wen dem dey do party and di sakrifice wey e dey offa for di temple. All dis tins kon sopraiz di kween well-well and fear katch am.

6E tell Solomon, “Wetin I hear for my kountry about yor wisdom, na true!

7But I nor bilive until naw wey I don kom si evritin by mysef. I nor even hear half of wetin I don si; bikos yor wisdom and propaty many pass as dem tell mi.

8Yor ofisas and savants go dey happy well-well, bikos dem always dey with yu, dey hear di wise tins wey yu dey tok!

9Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”

10Sheba kween give Solomon all di gifts wey e bring and dem heavy rish 120 pounds for gold, with plenty spices and jewels. Di spices wey e give Solomon, plenty pass di ones anybody don ever gi-am before.

11(Hiram pipol wey karry gold kom from Ofir, still bring plenty fine wood and jewels.)

12King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.

13Solomon give Sheba kween evritin wey e ask for kon still gi-am oda tins, just as dia tradishon bi, den di kween and en pipol kon go back to Sheba.

14Evry year, dem dey give Solomon gold wey heavy rish 666 pounds.

15Dis one nor dey join di tax wey tradas, Arab kings and di govnors for Israel dey pay gi-am.

16Solomon use gold wey rish fifteen pounds take make two hundred shield.

17E still use gold wey almost rish four pounds take make three hundred shield kon put all of dem for di hall wey dey Lebanon forest.

18E still make one big throne. Dem kover one side for di throne with ivory kon kover di oda side with fine gold.

19Na six steps dey to klimb go di throne and for di end for evry step, dem mold lion put, so all di lion kon bi twelf.

20Dem mold melu head for di throne back and near di two chair hand. Dem still mold anoda lion put for di throne. E nor get any throne wey bi like dis for any oda kingdom.

21Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.

22Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.

23Solomon get propaty and e wise pass any oda king.

24Evribody for di world dey won kom hear di wise tins wey God give Solomon to tok.

25Evribody wey dey kom, dey bring gold, silva, robes, weapons, spices, horse and mule. And dem dey bring dem kom evry year.

26Solomon gada many horse and shariot. E get 14,000 shariot and 12,000 ordinary horse. E keep dem for difren towns for Jerusalem.

27Wen Solomon dey rule, silva dey evriwhere like ordinary stone for Jerusalem and cedar tree dey kommon like ordinary trees for Jerusalem.

28Solomon buy en horse from Egypt and Silisia; doz wey dey sell for di king, na dem buy dem kom from Silisia for di normal prize.

29Dem dey buy one shariot from Egypt for 600 silva and ordinary horse for 150 silva. Den dem go re-sell am give Hit and Siria kings.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 10.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.