1 John 1pcm

1Di tin wey dey from di biginnin, wey wi don hear and si with awa eye; wey awa hand don tosh (tins wey koncern di word wey dey give life

2and dis life kom out and wi don si am. Na dis tins wi dey tok about. Wi dey tell una about di life wey nor dey end, wey dey with di Papa for heaven and E don show am to us.

3Na wetin wi don si and hear, wi dey tell una, so dat una go fit bi awa friend, just as wi bi friend with di Papa and en Pikin.)

4Na dis make us dey rite dis leta, so dat awa joy go full well-well.

5Na di message wey wi hear from am, naim wi dey tell una so: Na God bi lite and darkness nor dey inside am at-all.

6If wi sey wi bi en friend and wi still dey inside darkness, wi dey lie and trut nor dey awa mout.

7But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.

8If wi sey wi nor get sin, wi dey deceive awasef and di trut nor dey inside us.

9But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.

10If wi sey wi nor dey sin, dat mean sey, God dey lie and di trut nor dey inside us.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 John 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.