1 Chronicles 26pcm

1Doz wey dey guide di temple, na dia names bi dis: From Korah tribe: Meshelemaya wey Kore born and e kom from Asaf family.

2Meshelemaya sons na: Zekaraya wey bi senior, before Jediael, Zebadaya, Jatniel,

3Elam, Jehohanan and Eliehoenai.

4Obed-Edom sons na: Shemaya wey bi senior, before Jehozabad, Joah, Sakar, Netanel,

5Ammiel, Issakar and Peulletai. (True-true, God bless Obed-Edom.)

6Obed-Edom first pikin Shemaya still born sons wey bi leaders and pipol dey respet dem well-well.

7Shemaya sons na: Otni, Refael, Obed, Elzabad. En relashon na Elihu and Semakaya and pipol dey respet dem too.

8All dis na Obed-Edom family. Pipol dey respet dem well-well, bikos dem sabi do dia work. Dem bi sixty-two wey rilate to Obed-Edom.

9Meshelemaya get eighteen sons and rilashons wey pipol dey respet well-well.

10Hosah wey kom from Merari family born four boy and dem bi: Shimri (en papa make am di first-born, even doh nor bi en dem first-born),

11di sekond na Hilkaya, before Tebalaya and Zekaraya. Na thirteen pipol for Hosah family bi guide for di temple.

12Dem divide di temple guards, just as dia family bi and dem give dem work for di temple, just as dem give di oda Levi pipol.

13Di pipol from each family trow dice, both yong and old, just to know di work wey dem go do.

14Di dice for di east gate na for Shelemaya and en pikin, den Zekaraya wey dey give betta advise kon take di nort gate.

15Dem give Obed-Edom di gate for sout sey make en sons dey guide di store room.

16Na Shuppim and Hosah dem give di west gate and Shalleket gate wey dey di road for up. Di guards dey shange duty among demsef.

17Evriday, six guards dey-dey for di east, four for nort and four for sout. But na four guards dey-dey di store room, two-two for one side.

18Na four guards dey di kourt for di west, while two dey inside di kourt.

19Dis na how dem take divide di guards wey bi Korah and Merari family.

20Oda Levi pipol dey guide di precious tins wey dey di temple and di store room wey dem put di tins wey dem dedikate give God.

21From Ladan family wey kom from Gershon tribe, na Jehiel bi dia leader.

22Na Jehiel sons, Zetam and Joel dey kare for di store room for di temple.

23Di leader wey kom from Amram, Izhar, Hebron and Uzziel family na:

24Shebuel wey Moses pikin Gershom born, na-im dey supavise di store room.

25En relashon thru Elieza na: Rehabaya, Jeshaaya, Joram, Zikri and Shelomit.

26Evry gift wey King David, di leaders, doz wey dey lead tazon and hundred sojas dedikate give God, na Shelomit and en relashon dey guide dem for di temple.

27Dem don dedikate some of di tins wey dem karry from war give God for di temple.

28Evritin wey Profet Samuel, Kish pikin Saul, Ner pikin Abner and Joab pikin Zeruaya dedikate give God for di temple, na Shelomit and en rilashons dey guide dem.

29But for Izhar family, dem give Kenanaya and en shidren work outside di temple, as ofisas and judge for Israel.

30As for Hebron family: Hashabaya and en relashon wey bi 1,700 men wey pipol dey respet, na dem dey work for di west side for Jordan River for Israel. Dem do God work and wetin di king wont.

31For Hebron family, na Jeraya bi leader just as dem rite am. For di forty years wen King David dey rule, dem shek where dem rite am put kon si sey, dis men na pipol wey pipol dey respet for Jazer wey dey Gilead.

32King David choose 2,700 men from Jeriaya relashon wey pipol dey respet well-well kon sey make dem dey lead Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe. Na dem dey judge any matter wey koncern God and di king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 26.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.