1 Chronicles 18pcm

1Leta, David attack and win Filistia pipol again kon take Gat town with all en village.

2E still win Moab pipol kon bigin rule and kollect tax from dem.

3Afta, David attack King Hadadeza for one Siria land for Zobah near Hamat aria. King Hadadeza bi won take-ova di aria for Eufrates river side.

4David seize Hadadeza 1,000 shariot, 7,000 men wey dey ride horse and 20,000 sojas wey dey waka with leg. David keep many horse for war kon break di rest ones leg.

5Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.

6Den David set soja kamp for dia aria kon dey rule and kollect tax from dem. God give David viktory for evriwhere.

7David karry all di gold shield wey Hadadeza sojas take dey guide diasef for war, go Jerusalem.

8E still take many bronze from Tibhat and Kun where Hadadeza for dey rule. (Na Solomon use all dis bronze take build tank, kolumns and oda bronze tins for di temple.)

9Wen King Toi for Hamat hear sey David don win and kollect all Hadadeza sojas,

10e send en pikin, Joram go greet David, bikos e win King Hadadeza. (King Toi don fight with King Hadadeza well-well before, but e nor fit win am.) Joram karry gold, silva and bronze follow body go.

11King David dedikate dis tins to God with di gold and silva wey e win from Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol.

12Abishai, wey en mama na Zeruaya, kill 18,000 Edom men for Salt Valley.

13E put guards for Edom. Na King David dey rule all di pipol for der and God make David win all en war.

14David rule Israel land kon make sure sey dem dey trit en pipol well.

15Abishai wey bi Joab broda, naim bi di sojas oga and na Jehoshafat wey Ahilud born, dey keep rekord.

16Ahitub pikin Zadok and Ahimelek wey Abiatar born, na dem bi priests, while Shavsha kon bi seketry for di kourt.

17Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim dey lead David bodyguards and David sons na shiefs ofisas too.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 18.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.